China declare support for Nigeria, oppose US President Trump threat of military action

US President Donald Trump, Nigeria President Bola Tinubu and China govment spokesperson Mao Ning

Wia dis foto come from, Getty Images/Nigeria Presidency/Chinese Embassy in Nigeria

China don kick against US threats of sanctions or military actions against Nigeria on top allegations of Christian genocide for di kontri.

Di Chinese govment announce dia position wen dia Foreign Ministry tok-tok pesin Mao Ning address one press conference for Beijing on Tuesday, 4 November.

Di press conference dey come afta US President Donald Trump on 31 October declare Nigeria as a “country of particular concern” sake of allegations say Christian communities dey threatened.

Di Chinese govment declare dia support for Nigeria govment and say dem dey against any kontri wey dey chook mouth for oda countries mata under di disguise of religion and human rights.

“As a comprehensive strategic partner of Nigeria, China firmly support di Nigerian govment in leading its people to a development path wey fit Nigeria national reality.

“We oppose any country interference for oda countries’ internal affairs under di pretext of religion and human rights. We oppose di wanton threat of sanction and use of force.” China tok-tok pesin Mao Ning tok.

Skip X post

Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

US Congressman reply China

Meanwhile US Congressman Riley M. Moore wey dey represent West Virginia Second District for di U.S. House of Representatives wey dey part of dos wey blow di mata reply China say, dem no go dictate US foreign policy to dem.

E add say, “Communist autocracy wey recently arrest 30 Christian pastors for dia faith and throw ethnic minorities for concentration camps no go lecture dem.

President Trump dey absolutely right to defend our brothers and sisters in Christ wey dey suffer horrific persecution, and even martyrdom, for dia faith in our Lord and Savior Jesus Christ.” Oga Moore write for one post on X.

Ecowas reject claims against Christian genocide for Nigeria

In di same vein, di Economic Commission of West African States (Ecowas) don reject di claims say Christian genocide dey for Nigeria.

For one statement wey di body release on Tuesday, Ecowas say di claims say terrorists groups dey target one group or di claim say genocide of one religious groups dey for di region na false and dangerous claim.

Dem alert international communities to di growing level of violence wey terrorist groups of different coloration don carry out for some countries for di West African region, including Nigeria.

“Perpetrators of dis violence dey target innocent civilians of all religious denominations including Muslims, Christians, and pipo of oda religions. As independent reports don confam ova di years say, terrorist-related violence no dey discriminate on di basis of gender, religion, ethnicity or age.”

Dem call on di United Nations and all partners to support Member States in dia fight against these groups and to treat as false any claims wey say these terrorists’ groups dey target one group.

E say dis na sake of how dem dey kpai ‘thousands of Christians’ for di kontri.

Trump tok dis one for post wey e make for im Truth Social on Friday, wia e add say Christians for Nigeria dey face threat.

“Christianity dey face existential threat for Nigeria. Dem dey kill thousands of Christians. Radical Islamists dey responsible for dis mass slaughter.”

“I dey hereby make Nigeria a ‘country of particular concern’ – but dat na di least of am.”

Di US president say im don direct im congress pipo to look into di mata and make dem report back to am as dem no fit stand dey look dis kain ‘attrocities’ dey happun for Nigeria.

“Wen Christians, or any such group dey slaughtered lik e dey happun for Nigeria, sometin get to be done.”

“I dey ask Congressman Riley Moore, togeda wit Chairman Tom Cole and di House Appropriation Committee, to immediately look into dis mata, and report back to me.”

Also, for one post on im Truth Social platform on Saturday, Trump tok say im don ask Pentagon to map out possible plan of attack in Nigeria, one day one day afta e warn say Christianity dey “face ogbonge threat” for di West African nation.

On Sunday, President Trump repeat im threat of possible military operations for Nigeria on top di alleged killings of Christians.

Trump no tok about di exact killings e dey refer to but claims of genocide against Nigeria Christians don dey circulate in recent weeks and months for some right-wing US circles.

Groups wey dey monitor violence say evidence wey suggest say dem dey kill Christians pass Muslims no dey for Nigeria, country wey get plenty followers for di two religions.

Nigeria President Bola Tinubu don insist say religious tolerance dey di country and say di security challenges dey affect pipo “across faiths and regions”.

Nigeria don get religious and ethnic tensions for long, particularly for di northeast, wia Islamist groups like di Boko Haram and Islamic State West Africa Province don carry out deadly attacks pass 10 years.

For di North central states of Plateau and Benue, hundreds of pipo don die, sake off armers and herders clashes.

Wetin be genocide?

Na one Jewish-Polish lawyer Raphael Lemkin coin di word for 1943, e combine Greek word “genos” (race or tribe) wit di Latin word “cide” (to kill).

Afta e witness di horrors of di Holocaust, wia dem kill evri member of im family except im brother.

Dr Lemkin campaign to make sure say dem recognise genocide as a crime under international law.

Im efforts lead to di adoption of di United Nations Genocide Convention for December 1948, wey come into force in January 1951. As at 2022, 153 countries don accept am.

Article Two of di convention define genocide as “any of di following acts committed wit di intent to destroy, in whole or in part, national, ethnic, racial, or religious group, such as”:

  • Kill members of di group
  • Cause serious bodily or mental harm to members of di group
  • Deliberately impose on di group conditions of life calculated to cause physical destruction of di group, in whole or in part
  • Impose tins wey go go make di group no born children
  • Use force transfer children of di group to anoda group

Di convention also impose general duty on signatory states to “prevent and to punish” genocide.



Source link

Visited 1 times, 1 visit(s) today

Related Article

In Delhi, a week after cloud seeding trails, the air quality which although saw marginal improvement today with the overall AQI recorded at 228 at 9 am, it still remained under the ‘poor’ category. (Vipin Kumar/Hindustan Times)

As Delhi breathes ‘poor’ air, China offers help to tackle pollution crisis

As Delhi continues to grapple with ‘poor’ Air Quality Index (AQI), China on Wednesday offered to help India battle its severe air pollution crisis, especially in the national capital and its surrounding areas. In Delhi, a week after cloud seeding trails, the air quality which although saw marginal improvement today with the overall AQI recorded

1cr con on doc: Lens on China, Cambodia links

1cr con on doc: Lens on China, Cambodia links | Mumbai News

Navi Mumbai: Seven members of a gang have been arrested by Navi Mumbai cyber police for cheating a 40-year-old orthopaedic surgeon from Kharghar of Rs 1.1 crore after luring him into investing in fake shares online over two months. They claimed that the masterminds were in China and Cambodia. Police said the defrauded money was

China offers to help tech companies solve ‘major AI problem’ but on one condition

China offers to help tech companies solve ‘major AI problem’ but on one condition

China is reportedly offering a solution to every AI company’s biggest problem – soaring energy bills. The country’s government is reportedly increasing financial incentives for data centres, offering tech companies subsidies that cut their energy bills by up to half. The move is a direct effort to boost China’s homegrown semiconductor industry and sustain its

Buildings are seen along Miami Beach in Florida. A US appeals court on Tuesday cleared the way for Florida to enforce a law restricting real estate and land purchases by Chinese citizens. Photo: Shutterstock

Florida ban on Chinese-owned property, sea goddess ceremony concern: SCMP daily highlights

Catch up on some of SCMP’s biggest China stories of the day. If you would like to see more of our reporting, please consider subscribing. 1. Nexperia fallout: chip spat reignites EU debate over Chinese investments The saga of Netherlands-based and Chinese-owned chipmaker Nexperia, caught up in broader geopolitical tensions between the United States and

Could Bitcoin, Ethereum, XRP rebound last?

Could Bitcoin, Ethereum, XRP rebound last?

Bitcoin (BTC) is holding above $100,000 at the time of writing on Wednesday, following a knee-jerk bounce after two consecutive days of declines. BTC corrected below $99,000 on Tuesday as risk-off sentiment continued to spread across the cryptocurrency market.  Recovery has become elusive, especially as investors remain on the sidelines due to macroeconomic uncertainty and

Soybeans, corn ease after rally; spotlight on US-China talks — TradingView News

Soybeans regain ground as China-U.S. truce assessed — TradingView News

By Naveen Thukral and Gus Trompiz Chicago soybeans rose on Wednesday to recover some of the previous session’s losses, as Beijing’s confirmation that it was cutting tariffs on U.S. farm goods put attention back on a trade truce between the countries. Gains remained capped by the lack of large Chinese purchases of U.S. crops since

Customers at a Luckin Coffee Inc. store in Shanghai on November 22, 2024.

Starbucks once seemed unstoppable in China. Its US owner is now giving up control

Beijing/Hong Kong  —  Nearly three decades ago, Starbucks opened its first outlet in China with much fanfare, involving a troupe performing a traditional “golden lion” dance and eager customers trying cappuccinos made with steaming espresso machines. The entry of the American brand helped spur the rise of a thriving coffee culture among the burgeoning middle